Pages

Friday 21 February 2014

Sabusi's "OMILA" (THEFT) Broken Down (ENA OFUGARA)


CBN under Sanusi spent 3.086 billion on adverts and promotions in 2012 (Which enabled him "win" Central Bank Gov of Year Award)
Na wetin CBN dey sell wey dem dey spend such money for advert? Coca Cola and Alomo Bitters no spend reach so)
He expended N20.202 billion on ‘Legal and Professional Fees’ in 2011.
(Na Rotimi Williams spirit and Teslim Elias own he employ from grave and na for Court of Paradise them judge the cases wey chop such monies)
Lunch for Policemen and private guards gulped N1.257 billion in 2012 under Sanusi.

(President wey dey get foreign visitors and family and wey dey send cow gifts and wey dey feed his team them....the whole Aso Rock village morning noon night and snack 1 billion. Only LUNCH for police and soldiers wey dey guard CBN compound 1BILLIONsssssss two hundredssss and fifty millionssssssss.
Na Pegassus and Phoenix and such creatures be their meat and chicken I sure.)

CBN spent N2bn on chartered planes, paid Emirate Airline (that does not operate local flight) N511 Million, Wing Airline (that is not registered anywhere in Nigeria) N425 Million and Associated Airline N1.025bn to distribute currency by air nationwide, yet Associated Airline does not have a billion turnover in 2011

(Na Paradise Sanusi Charter the plane them go. He fit done fly go collect him virgin already, come back because this money for flight....no be London or America money be this)

“Currency Issue Expenses”; N1.158bn, Sundry Currency charges; N1.678bn,

(1.158 billion to print money in one year. That money go dey scent full house. No naira suppose old. All suppose crisp)

Facility Management N7.034bn in 2012 (what facility is CBN managing),

(To maintain buildings of CBN...building wey dem done build wey nobody dey waka near or piss near....to maintain am in one year 7 billionssssss 340 thousand nairasssssss. Yet the bastard dey complain for NNPC wey maintain their properties inside sea plus far-flung places and facing sabotage money.)


Training and travel expenses; N9.24bn in 2012 and N7.65bn in 2011,

(Na who Central Bank train wey be 9.2 billlion? Na Aristotle and Plato be their Teacher and them fly go THE REPUBLIC)

expense on newspapers, books and periodicals (excluding CBN’s publications) is N1.678 billion in 2012.

( Shege Barawo!!!! This Vanguard and Guardian and Sahara Reporter naim be 1 billionsssss six hundred and senventy eight thousandsssss nairasssssss so??????
Una done use una eye see CBN publication even for any bank wey una sitdown dey wait to collect money before? As I like to read reach, I NEVER USE MY EYE SEE CBN PUBLICATION once. The copies must be few and yet 1.678 billions expended. TIME MAGAZINE no dey spend that kine money sef)

CBN paid N38.233 billion to the Nigerian Security, Printing and Minting Company Limited in 2011, but NSPMC reported total revenue of N29.37 billion for all its transactions with all clients including the CBN.

(How manage?)

SANUSI see this wahala coming 2012 naim he start to holler 49.8 billion....no no 10 billion....no no.....12....okay finall final 20 billion is missing. Yar"Adua the real president and not the fake one said no more kerosine subsidy.

Now people wey no dey reason correct dey say dem dey oppress am. OMILA, THIEF, JANKOLIKO short ete like am dey thief money wey tall pass am.

Una dey talk of Bulletproof motor wey Stella buy. This guy dey fall full country avccount. See the Anini we put to look our money.

Where the tyre and matches? Petrol nko? Bring am come. We want to.......

0 comments:

Post a Comment